[GUEST ACCESS MODE: Data is scrambled or limited to provide examples. Make requests using your API key to unlock full data. Check https://lunarcrush.ai/auth for authentication information.] [@iOccupyNigeria](/creator/twitter/iOccupyNigeria) "Naija GDP dey grow pass Europe abeg show us which economist talk am. Na GDP growth we wan chop Na hunger be dat Lagos na fastest tech hub for world who dash us Even Cape Town Nairobi Kigali dem dey pass us for tech funding infrastructure and investor confidence. Debt-to-GDP dey drop drastically false. Nigeria debt rise reach XXX trillion in 2024. Debt-to-GDP hit almost 50%. Plus we dey use XX% of revenue to service am. Wetin dey drop Make una no use half-truth dey guilt-trip people wey dey suffer. If Lagos dey smell na because system don rot. Talk that one too. If we go build new Nigeria" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1976400325134438690) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-09T21:32Z XXX followers, 2270 engagements "Una dey yarn say Tinubu work for Deloitte Arthur Andersen ExxonMobil even Haskins & Sells but make we break am down with correct receipt: Deloitte USA reply subpoena say dem no get any record say Bola Ahmed Tinubu ever work for their company. Word for word dem talk say: We have no employment records for him in our system. Na public document. No be rumour. (Sahara Reporters) Another report from TheWill News confirm say Deloitte deny ever employing Tinubu. So this one no be social media gist. Arthur Andersen wey dem say he work for that company don collapse since 2002 because of the Enron" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1976685774365221254) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-10T16:26Z XXX followers, 7110 engagements "Una dey drag Obi say e support Argentina president reforms. But guess wetin Argentina just secure $XX billion bailout with U.S. backing. Meanwhile Nigeria under Tinubu don drag in only $X billion FDI since e enter office. No bailout. No rescue. Just suffer. I no even support Obi but maybe if e enter and do wetin dem do we for don collect our own $40B too. But una choose city boy. Enjoy am" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978901761361334684) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-16T19:12Z XXX followers, XX engagements "EFCC say dem don transform Transform into wetin political police 😂 Wetin EFCC transform into na broom-cleaner for APC big men. You pledge loyalty case disappear. Na opposition dem dey catch parade disgrace. But APC ogas Na performance charter dem dey write. Make I remind una: Akpabio: N100bn EFCC case. As e enter APC matter die. Today na Senate President. Orji Uzor Kalu: N7.6bn fraud. Supreme Court cancel am. EFCC no refile case. Obanikoro: Billions recovered. Now na witness because e switch to APC. Adamu: Investigated for shady land deals. APC chairmanship clear the road. Timipre Sylva:" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978956294368432263) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-16T22:48Z XXX followers, XX engagements "Argentina get $40B bailout. Nigeria get $2B. Who really dey run Ponzi 😂 Milei: Inflation: 276%55% Poverty: 57%38% Peso gain XX% GDP +3.9% Fired 52k staff Got $40B from US Tinubu: Inflation: 30%18% 129M poor 4601300/$ GDP +4.2% Villa feeding budget Got $2B total Results no lie. Ponzi no be who talk am na who dey beg $" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978957516060135726) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-16T22:53Z XXX followers, XXX engagements "My guy how person go get PhD but still dey reason like say common sense no dey You dey talk say you dey pay XX% tax for UK fine. But that XX% dey show for your life: hospital dey work road smooth light no dey blink system dey respect human being. You fit see where your money dey go. For Naija even if you pay X% tax wetin government dey do for you Na you still go buy fuel for gen pay for borehole pay school fees guard your own house and still bribe person wey suppose serve you. So tell me wetin exactly our tax dey achieve Make nobody use UK compare Nigeria again abeg here na survival no be" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1979049559394312622) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-17T04:59Z XXX followers, XXX engagements "This man dey always talk like person wey don chop small ogogoro before press conference. How you go dey compare yourself a federal minister wey dey control Abuja with billions from national budget to a state governor wey dey hustle internally generated revenue and still get Assembly and opposition to answer to Wike no dey even reason. Abuja no get state legislature no get political opposition and almost every major project there dey come from national allocation. Obi for Anambra no even see one percent of that kind money. Na like say person wey dey use trailer engine dey brag say e win" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1979051237589795070) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-17T05:05Z XXX followers, XX engagements "My brother make we no dey play this anonymous aide film again. So all these best brains wey Tinubu gather around am no sabi read charge sheet Person name dey list for murder drugs or kidnapping dem no know wetin e do before dem add am Abeg make una respect Nigerians small. This government too like lie wey wear agbada. Every time e bad na aide talk am. Every time e sweet na Mr President achieve am. Accountability no be buffet wey you pick only wetin sweet you" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1979070051027177769) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-17T06:20Z XXX followers, XX engagements "@MasterBolaji X Dem say economic reforms dey work. But na only for Excel sheet and press release. For real life na still wahala full ground. Make I break am down" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1976185453746249976) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-09T07:18Z XXX followers, XXX engagements "BREAKING: Na sand dem dey use do propaganda now 😂 Dem dey shout say Nigeria don export solar panel go Ghana like say na moon we land. China dey produce solar panel for less than XX cents per watt dem dey ship am reach every corner of di earth still cheaper than to drag am from Lagos go Accra. Wetin be di revolution here Which one Na extension cord revolution Abi na inverter wey no dey charge Dem dey hype 650MW capacity but China dey build gigafactories wey dey drop 100000MW+ per year. Even small countries like Vietnam Malaysia even Tunisia don dey export solar panels tey tey. Ghana sef get" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1976396605575119325) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-09T21:17Z XXX followers, 2923 engagements "$300bn FDI from Qatar ke 😂 Make we reason am with numbers: Qatar GDP na about $223bn (2025 IMF) how dem wan pledge more than their whole economy to one country IMF Even Qatar Investment Authority (QIA) get around $526$557bn AUM dem no dey carry over half of dia entire fund dash one market. SWFI/Bloomberg est. All Africa collect roughly $4853bn FDI for 2023 so $300bn to Nigeria alone na fairy tale. UNCTAD Reality check for Naija: NBS talk say FDI enter just $119m (Q1 2024) and $29.83m (Q2 2024) na mostly hot-money portfolio dey come no be long-term factories. NBS Abeg respect Nigerians. Stop" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1977753329405968827) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-13T15:08Z XXX followers, XX engagements "Una dey whine us Qatar total GDP na $235bn una talk say dem wan dash Nigeria $300bn Even the maths dey vex. No be Emir of Qatar talk am o. Na one low-level royal no be even cabinet member. Even MBS for Saudi Arabia wey hold oil key no fit pledge that kain money. IMF just announce say Nigeria total FDI for 2024 na $1.9bn. So where this $300bn miracle dey come from Na photoshoot investment or na Ramadan dream Make una fear God. No use agbada and palace backdrop deceive XXX million people. #UseYourSense #FDINoBePhotoshoot #QatarNoBeFatherChristmas #NaLieNoDeyTireUna" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978114620620501308) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-14T15:04Z XXX followers, XX engagements "Una no dey shame at all. Person wey suppose dey rescue naira wey dey manage broken economy go dey burn scarce forex to go rest for UK Na so una dey manage economy una dey stress us here but una dey relax abroad. Na hotel una go pay flight estacode all on who Nigeria no be una private lounge. If im wan rest we get Obudu we get Yankari we get Ikogosi we even get Lagos Lagoon. This country belong to all of us no be una wey hijack am go dey use am like travel allowance. Respect Nigeria. Or resign" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978519825153425887) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-15T17:54Z XXX followers, XX engagements "Dem say foreign investors don dey show confidence for Nigeria economy again. Abeg confidence for which part exactly External reserves na $XXXX billion highest in five years dem talk. But how e take help the market when Naira still dey fall like mango for harmattan CBN say forex turnover don rise XX% to $XXX billion. Beautiful on paper but go any bank see if you fit collect PTA or BTA without writing novel-length application. Dem promise X% growth by 20272028. But same statement talk say IMF projection for 2025 na 4%. Which one we go believe reality or PowerPoint Oil export still be XX% of" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978810850732564637) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-16T13:10Z XXX followers, XX engagements "After all this wahala wey Nefertiti list from GDP crash to Japa to poverty to terrorism some people still open mouth dey say APC is trying Tinubu is trying. My brother if dem no pay you then na village people hold you. Nobody dey support this madness with clear eye. This one don pass politics na spiritual attack" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978873587390976320) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-16T17:20Z XXX followers, XX engagements "Dem Say Food Don Cheap Abeg Who Chop Am So Nairametrics just drop headline say: Nigeria records first month-on-month food deflation in over XX years. Dem talk say food prices go down for September 2025 and everybody suppose dey clap Omo make una calm down make we break this thing properly. X. Na Harvest Season No Be Tinubu Miracle Even the article talk am clearly: The harvest season across major agricultural regions has helped boost food supply So wait na cassava and maize season come reduce price and una dey run headline like say na government economic policy cause am Pepper yam rice dey" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1979161426741665864) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-17T12:23Z XXX followers, XX engagements "@Franeb Death by Murder o" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1978580168831590850) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-15T21:54Z XXX followers, XX engagements "Make e clear like daylight Massad Boulos no dey anywhere for U.S. government hierarchy. E no appear for White House list e no get appointment letter e no dey under State Department or any official U.S. agency. Nothing. Zero. The man na Trump in-law and e only dey act as adviser for Trump personal or campaign side no be for American government wey dey power now. So make we no deceive ourselves this no be U.S. government meeting na personal meet-and-greet. No policy no diplomacy just photo-op and packaging" [X Link](https://x.com/iOccupyNigeria/status/1979228573232959711) [@iOccupyNigeria](/creator/x/iOccupyNigeria) 2025-10-17T16:50Z XXX followers, XX engagements
[GUEST ACCESS MODE: Data is scrambled or limited to provide examples. Make requests using your API key to unlock full data. Check https://lunarcrush.ai/auth for authentication information.]
@iOccupyNigeria
"Naija GDP dey grow pass Europe abeg show us which economist talk am. Na GDP growth we wan chop Na hunger be dat Lagos na fastest tech hub for world who dash us Even Cape Town Nairobi Kigali dem dey pass us for tech funding infrastructure and investor confidence. Debt-to-GDP dey drop drastically false. Nigeria debt rise reach XXX trillion in 2024. Debt-to-GDP hit almost 50%. Plus we dey use XX% of revenue to service am. Wetin dey drop Make una no use half-truth dey guilt-trip people wey dey suffer. If Lagos dey smell na because system don rot. Talk that one too. If we go build new Nigeria"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-09T21:32Z XXX followers, 2270 engagements
"Una dey yarn say Tinubu work for Deloitte Arthur Andersen ExxonMobil even Haskins & Sells but make we break am down with correct receipt: Deloitte USA reply subpoena say dem no get any record say Bola Ahmed Tinubu ever work for their company. Word for word dem talk say: We have no employment records for him in our system. Na public document. No be rumour. (Sahara Reporters) Another report from TheWill News confirm say Deloitte deny ever employing Tinubu. So this one no be social media gist. Arthur Andersen wey dem say he work for that company don collapse since 2002 because of the Enron"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-10T16:26Z XXX followers, 7110 engagements
"Una dey drag Obi say e support Argentina president reforms. But guess wetin Argentina just secure $XX billion bailout with U.S. backing. Meanwhile Nigeria under Tinubu don drag in only $X billion FDI since e enter office. No bailout. No rescue. Just suffer. I no even support Obi but maybe if e enter and do wetin dem do we for don collect our own $40B too. But una choose city boy. Enjoy am"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-16T19:12Z XXX followers, XX engagements
"EFCC say dem don transform Transform into wetin political police 😂 Wetin EFCC transform into na broom-cleaner for APC big men. You pledge loyalty case disappear. Na opposition dem dey catch parade disgrace. But APC ogas Na performance charter dem dey write. Make I remind una: Akpabio: N100bn EFCC case. As e enter APC matter die. Today na Senate President. Orji Uzor Kalu: N7.6bn fraud. Supreme Court cancel am. EFCC no refile case. Obanikoro: Billions recovered. Now na witness because e switch to APC. Adamu: Investigated for shady land deals. APC chairmanship clear the road. Timipre Sylva:"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-16T22:48Z XXX followers, XX engagements
"Argentina get $40B bailout. Nigeria get $2B. Who really dey run Ponzi 😂 Milei: Inflation: 276%55% Poverty: 57%38% Peso gain XX% GDP +3.9% Fired 52k staff Got $40B from US Tinubu: Inflation: 30%18% 129M poor 4601300/$ GDP +4.2% Villa feeding budget Got $2B total Results no lie. Ponzi no be who talk am na who dey beg $"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-16T22:53Z XXX followers, XXX engagements
"My guy how person go get PhD but still dey reason like say common sense no dey You dey talk say you dey pay XX% tax for UK fine. But that XX% dey show for your life: hospital dey work road smooth light no dey blink system dey respect human being. You fit see where your money dey go. For Naija even if you pay X% tax wetin government dey do for you Na you still go buy fuel for gen pay for borehole pay school fees guard your own house and still bribe person wey suppose serve you. So tell me wetin exactly our tax dey achieve Make nobody use UK compare Nigeria again abeg here na survival no be"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-17T04:59Z XXX followers, XXX engagements
"This man dey always talk like person wey don chop small ogogoro before press conference. How you go dey compare yourself a federal minister wey dey control Abuja with billions from national budget to a state governor wey dey hustle internally generated revenue and still get Assembly and opposition to answer to Wike no dey even reason. Abuja no get state legislature no get political opposition and almost every major project there dey come from national allocation. Obi for Anambra no even see one percent of that kind money. Na like say person wey dey use trailer engine dey brag say e win"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-17T05:05Z XXX followers, XX engagements
"My brother make we no dey play this anonymous aide film again. So all these best brains wey Tinubu gather around am no sabi read charge sheet Person name dey list for murder drugs or kidnapping dem no know wetin e do before dem add am Abeg make una respect Nigerians small. This government too like lie wey wear agbada. Every time e bad na aide talk am. Every time e sweet na Mr President achieve am. Accountability no be buffet wey you pick only wetin sweet you"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-17T06:20Z XXX followers, XX engagements
"@MasterBolaji X Dem say economic reforms dey work. But na only for Excel sheet and press release. For real life na still wahala full ground. Make I break am down"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-09T07:18Z XXX followers, XXX engagements
"BREAKING: Na sand dem dey use do propaganda now 😂 Dem dey shout say Nigeria don export solar panel go Ghana like say na moon we land. China dey produce solar panel for less than XX cents per watt dem dey ship am reach every corner of di earth still cheaper than to drag am from Lagos go Accra. Wetin be di revolution here Which one Na extension cord revolution Abi na inverter wey no dey charge Dem dey hype 650MW capacity but China dey build gigafactories wey dey drop 100000MW+ per year. Even small countries like Vietnam Malaysia even Tunisia don dey export solar panels tey tey. Ghana sef get"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-09T21:17Z XXX followers, 2923 engagements
"$300bn FDI from Qatar ke 😂 Make we reason am with numbers: Qatar GDP na about $223bn (2025 IMF) how dem wan pledge more than their whole economy to one country IMF Even Qatar Investment Authority (QIA) get around $526$557bn AUM dem no dey carry over half of dia entire fund dash one market. SWFI/Bloomberg est. All Africa collect roughly $4853bn FDI for 2023 so $300bn to Nigeria alone na fairy tale. UNCTAD Reality check for Naija: NBS talk say FDI enter just $119m (Q1 2024) and $29.83m (Q2 2024) na mostly hot-money portfolio dey come no be long-term factories. NBS Abeg respect Nigerians. Stop"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-13T15:08Z XXX followers, XX engagements
"Una dey whine us Qatar total GDP na $235bn una talk say dem wan dash Nigeria $300bn Even the maths dey vex. No be Emir of Qatar talk am o. Na one low-level royal no be even cabinet member. Even MBS for Saudi Arabia wey hold oil key no fit pledge that kain money. IMF just announce say Nigeria total FDI for 2024 na $1.9bn. So where this $300bn miracle dey come from Na photoshoot investment or na Ramadan dream Make una fear God. No use agbada and palace backdrop deceive XXX million people. #UseYourSense #FDINoBePhotoshoot #QatarNoBeFatherChristmas #NaLieNoDeyTireUna"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-14T15:04Z XXX followers, XX engagements
"Una no dey shame at all. Person wey suppose dey rescue naira wey dey manage broken economy go dey burn scarce forex to go rest for UK Na so una dey manage economy una dey stress us here but una dey relax abroad. Na hotel una go pay flight estacode all on who Nigeria no be una private lounge. If im wan rest we get Obudu we get Yankari we get Ikogosi we even get Lagos Lagoon. This country belong to all of us no be una wey hijack am go dey use am like travel allowance. Respect Nigeria. Or resign"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-15T17:54Z XXX followers, XX engagements
"Dem say foreign investors don dey show confidence for Nigeria economy again. Abeg confidence for which part exactly External reserves na $XXXX billion highest in five years dem talk. But how e take help the market when Naira still dey fall like mango for harmattan CBN say forex turnover don rise XX% to $XXX billion. Beautiful on paper but go any bank see if you fit collect PTA or BTA without writing novel-length application. Dem promise X% growth by 20272028. But same statement talk say IMF projection for 2025 na 4%. Which one we go believe reality or PowerPoint Oil export still be XX% of"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-16T13:10Z XXX followers, XX engagements
"After all this wahala wey Nefertiti list from GDP crash to Japa to poverty to terrorism some people still open mouth dey say APC is trying Tinubu is trying. My brother if dem no pay you then na village people hold you. Nobody dey support this madness with clear eye. This one don pass politics na spiritual attack"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-16T17:20Z XXX followers, XX engagements
"Dem Say Food Don Cheap Abeg Who Chop Am So Nairametrics just drop headline say: Nigeria records first month-on-month food deflation in over XX years. Dem talk say food prices go down for September 2025 and everybody suppose dey clap Omo make una calm down make we break this thing properly. X. Na Harvest Season No Be Tinubu Miracle Even the article talk am clearly: The harvest season across major agricultural regions has helped boost food supply So wait na cassava and maize season come reduce price and una dey run headline like say na government economic policy cause am Pepper yam rice dey"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-17T12:23Z XXX followers, XX engagements
"@Franeb Death by Murder o"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-15T21:54Z XXX followers, XX engagements
"Make e clear like daylight Massad Boulos no dey anywhere for U.S. government hierarchy. E no appear for White House list e no get appointment letter e no dey under State Department or any official U.S. agency. Nothing. Zero. The man na Trump in-law and e only dey act as adviser for Trump personal or campaign side no be for American government wey dey power now. So make we no deceive ourselves this no be U.S. government meeting na personal meet-and-greet. No policy no diplomacy just photo-op and packaging"
X Link @iOccupyNigeria 2025-10-17T16:50Z XXX followers, XX engagements
/creator/twitter::463212276/posts